CORRUPTION TORI Season 2 EPISODE 2: UNA DO WELL

by | Jul 11, 2021 | Corruption News, PIDGIN | 0 comments

Kindly Share

Featured Video Play Icon

My people, welcome oo. As the first season of Nigeria popular pidgin TV programme on top anti graft Corruption bin dey close downbabd Season 2 bin wan start, Signature Communication and d producers of dis programme bin start serious preparation to make sure say d season make more impact on too this we fight against Corruption.
For Abuja, Signature Communications bin carry experts of Communications and journalism join body with staff of the company make dem fit to design the way wey dem go fit report corruption in a better way make the episodes of Corruption Tori get more impact.

Did event naim be d pre production conference for the Season 2 of Corruption Tori wey we dey now. The Deputy director Nigeria office of the MacArthur Foundation Dayo Olaide yarn say Corruption dey dance around for contri sake of people wey no dey ask question from government. E yarn say when all this we institutions dem get eyes on top dem well wel and dem come dey function well, corruption go dey expensive and nobody go really wan chuk hand.

The General Editor of Tell Magazine Anayo Agbo knack applause give Corruption Tori for dia contribution to help good governance for the contri. He yarn the producers of Corruption Tori say make dem get mind o, make dem no lose passion and make dem dey responsible to dis fight. E still warn dem say most of this people wey dey involved for corruption dey get hand for politics and dem go wan fight back or bribe the reporters dem, beht integrity must still dey with correct journalism wey get ethics as the watch word of the Corruption Tori producers.

Advertisement

Three days after the pre production conference finish, Signature Communications open clothe for the Season 2 of Corruption Tori.

MacArthur Foundation, wey be the people wey dey put money make Corruption Tori come Una screen knack the programme applause o. Dr Like Shettima wey be the Director of the Africa office of the foundation dey among the senior people wey show for the event, e yarn say the foundation dey happy with the programme well well. E say as d programme dey use we contri languages and pidgin take loud this war against Corruption, Corruption Tori don join contri people as part of the soldiers to win this fight.

Chairmo of the Independent Corrupt Practices and other Related Offences ICPC Prof Bolaji Owasanoye wey na Hassan Salihu stand for am say Corruption Tori stand out as e dey help dem for dia work to commit all this magomago from contri. He still yarn make all hands join for dis matter, make the programme still join body with the commission sake of Corruption must to fight back so everybody must put hand to fight am.

Advertisement

As Signature Communications dey start d Season 2 of Corruption Tori, the team leader and Oga producer of the programme Vinmartin Obiora Ilo thank the MacArthur Foundation well well for the opportunity wey dem give Corruption Tori to carry dis their anti Corruption work go deep more more. He come yarn say the real challenge wey the programme dey face na to get the real information wey dem need and to get this public officials of government to talk on top questions of corruption.

For dis Season 2, Ilo don yarn say d programme go dey even more interactive mean say everybody go fit participate sef as dem go take am commot for studio reach outside to hear how the people sef dey feel for dia own environment.

Minister of State for Labour and Employment Festus Keyamo carry congratulations give Corruption Tori

As we dey chuk leg for the season 2 of Corruption Tori, wetin we need from you na make you sef follow is fight Corruption. If you get any experience, or you sabi where Corruption dey happen or even the fighting of that Corruption wey you wan report, just reach us for dis address wey dey your screen. If you follow us fight Corruption, we sef go follow you. Together we go win dis war. Make we see again next week jare, until then abeg dey jeje o.

0 Comments

Submit a Comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Court Grants Ex-Minister Agunloye N50m Bail

Court Grants Ex-Minister Agunloye N50m Bail

Justice Jude Onwuegbuzie of the Federal Capital Territory (FCT) High Court Apo, on Thursday, granted bail to ex-Minister of Power and Steel, Olu Agunloye, in the sum of N50 million. Agunloye was arraigned on seven counts bordering on fraudulent award of a contract and...

× Join SIGNATURETV whatsapp group