CorruptionTori Season 2 Episode 4: Lawmakers abeg help us stop corruption

by | Jul 25, 2021 | Corruption News, PIDGIN | 0 comments

Kindly Share

Featured Video Play Icon

We don carry come proper for the Season 2 of Corruption Tori, where we dey tight belt to continue dis fight against Corruption till we pursue am commot before e chop contri finish. Una welcome.
No be everytime wey we go see government agency for Nigeria wey go face government officials dem, look dem for eyes tell dem say You sef join for the problem of dis contri.

E dey even more difficult for government agency to do dis kain tin if d matter na corruption matter.
But na exactry wetin happen for Abuja e never too tay, for 2 day capacity building workshop wey na Konrad Adenauer Foundation organize with House of Representatives committee on top anti corruption.
The theme wey dem pit for dis workshop na Fight Against Corruption- Wetin Legislature Suppose Do, and dem bin wan shine light put for the matter of this fight against Corruption give we Lawmakers dem make dem wake up join inside.

The Chairmo of the Independent Corrupt Practices and other related Offences Commission wey be ICPC for short Prof Bolaji Owasanoye first yarn the legislators say na only to dey react wey Corruption katakata don guest naim dem dey do. Dem no dey proactive. E remind dem say the legislature get the powers for law to do investigation, to expose and to even make sure say dem prevent any kain Corruption for all the levels of government for Nigeria.

Advertisement

For d second day of the workshop, the ICPC Chairmo come choose vawulence. D man no come there to play or talk for back of mouth as e yarn the lawmakers say na only mouth dem get. Dem go dey knack chest yarn say dem dey support Anti Corruption beht dem no dey take any action to fight am. E say when many of dis government officials dey office, na so dem go dey frustrate the work of anticorruption people. Beht when dem commot for office, fiam! Dem go suddenly turn to anti Corruption activist.
Prof Bolaji chuk eye for the other areas of we contri life, the law of Nigeria and the judiciary wey balance dey frustrate all the effort to stop Corruption for Nigeria. As e yarn, the Nigerian constitution naim be the biggest problem and roadblock for dis fight against Corruption while the laws of the court naim dey provide delay or escape road for people wey dey face Corruption charges.

The ICPC Chairmo talk say all this constituency project by we legislators don turn to pipe wey dey leak, big straw for where dem just dey waste contri money go. E say the commission bin don establish the constituency and executive initiative wey don make sure say over 700 abodon project of constituency don dey completed now. .

The Director General of the National Institute for Legislative and Democratic Studies, Prof Abubakar Suleiman ask make d legislature try change dia story and d things wey dem dey do wey dey make anti Corruption fight no work. E say make dem join body with dis anti Corruption agencies dem to fight.

Advertisement

E get one wise talk wey we Mama’s dem dey yarn especially when dem dey pound yam. Dem go say of you sabi pound, carry mortar pound inside. Beht if you no sabi, e go better make you pound for ground first. At the end, you go see which pounded yam dem go chop. If dem dey call person thief and everytime e pass, something must miss, e mean say d behaviour don align with the accusation justify am. Abi?

0 Comments

Submit a Comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Court Grants Ex-Minister Agunloye N50m Bail

Court Grants Ex-Minister Agunloye N50m Bail

Justice Jude Onwuegbuzie of the Federal Capital Territory (FCT) High Court Apo, on Thursday, granted bail to ex-Minister of Power and Steel, Olu Agunloye, in the sum of N50 million. Agunloye was arraigned on seven counts bordering on fraudulent award of a contract and...

× Join SIGNATURETV whatsapp group