Fake Affidavit: THE FRAUD – The Wayo Wey Dey Inside (Investigative Report)

by | Aug 9, 2021 | Corruption News, PIDGIN | 0 comments

Kindly Share

Featured Video Play Icon

Last Sunday, we carry Tori come of Winston Chuks Obikwelu, lawyer wey base for Abuja, wey fake husband of im wife tif im identity travel with im wife and children go Venezuela for where the wife come die.

This fake husband wey tif Mr Winston identity, im own name na Emmanuel Iladion, im been dey sell engine oil for roadside before. All e do to tif Mr Winston identity, na to swear affidavit for court say im name na Winston Chuks Obikwelu, finish. Naim e collect foreign affairs staff as im wife and with that affidavit, e get passport wey carry am to Venezuela with the wife of the man wey get the identity wey e tif. E enjoy all this jollofication before bubble burst.

Wetin we dey wonder na how Emmanuel take get dis affidavit wey put legal stamp for im mago mago behaviour?
Corruption Tori undercover reporter take time do investigate on top dis affidavit racket wey don dey get as e be as e don fetch foreign affairs wife and foreign posting for person.

Advertisement

We bin start dis investigation with correct question give we lawyer on top the matter of how to get affidavit for the correct legal way. We still bin wan know how e dey be for the case of document wey loss and wetin police get to do for d matter.

Dis one mean say police report suppose dey to guarantee say na true when any complainant talk say im document loss in any kind of way. Beht how dem dey collect dis one from police, for dis, we yarn Divisional Police Officer for Wuse Police Division for Federal Capital Territory, Abuja.

According by dis one now, mean say position of lawyer and DPO naim suppose be d process. Beht Corruption Tori investigation wey we do for Federal High Court for Maitama Abuja show say no be so e dey be o. The steps wey lawyer and DPO list for us no be wetin happen for dis affidavit racket.
Na for gate naim security man first of all hold we reporter and d reporter kuku pretend like say e no sabi how dem dey get dis affidavit at all. The security man come tell am say e better make he, the security o, help am get dis affidavit, if not to get d document gotake time well well.

Advertisement

As dem settle on d money wey dem go pay Oga security for im affidavit producing service, d security come gist our reporter say to get police extract get easy way too. Na so e carry we reporter go one policeman for another round of pricing.

Without any kain report of wetin loss and how e take loss for any kain police station, we reporter no even chuk leg enter the police station for the Maitama court compound there to report how the thing take happen, beht Oga police come back with correct police extract wey dey talk the lie lie Tori wey we undercover reporter give am. Time come reach to waka go d admin block for where according by we lawyer, person suppose meet officer of law if e wan collect affidavit.

Of course nothing like that happen. Oga Security just tell we reporter make e wait small after e don give the police extract to somebody inside there. Kpakam! E never too tay wey one of the court official come outside call the name of we reporter, give am affidavit. The end.

So you still dey wonder how Emmanuel Iladion suddenly turn to Winston Chuks Obikwelu? You still dey think how Emmanuella suddenly change husband to another person like like who dey change wig for head? Come get passport carry fake husband and four children travel go Venezuela??
As e dey like this, if you want husband or wife, or you wan die on paper even as you dey alive so, or you wan turn to papa or mama or anybody children, or you wan turn pikin of another person parent, just go patronise affidavit market. Only say dem dem catch you, na only you go fit explain how you take enter security operative hand like Emmanuel Iladion. We dey wait for im day for court. One word don reach make wise man hear word. Till we carry come again next week Sunday with another Tori for Corruption Tori, make una dey jeje o.

0 Comments

Submit a Comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Court Grants Ex-Minister Agunloye N50m Bail

Court Grants Ex-Minister Agunloye N50m Bail

Justice Jude Onwuegbuzie of the Federal Capital Territory (FCT) High Court Apo, on Thursday, granted bail to ex-Minister of Power and Steel, Olu Agunloye, in the sum of N50 million. Agunloye was arraigned on seven counts bordering on fraudulent award of a contract and...

× Join SIGNATURETV whatsapp group